Climate Resilient Infrastructure Development Facility
| Official name | Climate Resilient Infrastructure Development Facility |
|---|---|
| Short name | CRIDF |
| Ein field of work | Climate change |
| Official language | British English |
| Continent | Africa |
| Country | South Africa |
| Member of | Department for International Development |
| Partnership with | Tetra Tech, COWI, SouthSouthNorth |
| Demma headquarters location | Pretoria |
| Dema official website | https://cridf.net/ |
| Contact page URL | https://cridf.net/contact/ |
| Interested in | Climate change, water supply, climate resilience |
Climate Resilient Infrastructure Development Facility (CRIDF), dem dey work with 12 kontris for Southern Africa side, na £31 million program wey UK's Foreign, Commonwealth & Development Office dey fund. Dem dey aim to fix water wahala wey dey worry over 200 million people, especially the poor ones, so life go better for dem long time.[1]
Climate Resilient Infrastructure Development Facility (CRIDF), na FCDO (Foreign, Commonwealth & Development Office) dey back am, dey work make dem find better solutions give water problem wey dey worry poor people for Southern Africa.[2]
CRIDF dey support how dem dey buy, get money, and watch over work wey dey go on for inside di kontri. Dis be for infrastructure projects wey, once dem finish, di kontri and local authorities, water/energy company dem, and di people wey go benefit go own and manage am.[3]
CRIDF be new water program wey Department for International Development (DFID) bring come for southern Africa. The program dey plan say for the next four years, dem go build small small infrastructure for water wey go last, for 'bout 11 Southern African Development Community (SADC) countries. De office dey Pretoria, South Africa, and de program dey focus on water, how to manage water well, den farming, so say water, food, and light for de area go dey alright for long time.[4]
Apart from dey help plus the irrigation schemes design under the UNDP-GEF project for show people how to make better lives, CRIDF dey push support give OKACOM-EU project too. Dem design four hydrometric stations wey dem go set up for inside the basin.[5]
Works
[edit | edit source]CRIDF ein main job be say, dem wan change how we dey use water things so say e go help Southern Africans wey dey suffer fit stand strong against climate change.[6]
However, CRIDF facilitates:
- Make all di countries come together do business so money go dey circulate well well for everybody;
- Work together manage di small small things wey we get wey cross borders, so development go dey go on, we go fit stand strong against climate change, plus solve wahala wey dey concern peace, who get power, and security;
- Help each other solve problems wey dey worry the whole region like changes for weather.[4]
Plus, CRIDF dey give some correct groups and projects quick sharp advice (RAS) wey dem fit chop quick quick if dem need help..[7]
References
[edit | edit source]- ↑ "Climate Resilient Infrastructure Development Facility". intdevtetratecheurope.com (in Australian English). Retrieved 2024-07-12.
- ↑ "CRIDF's aims and approaches | CRIDF" (in British English). 2017-07-03. Retrieved 2024-07-12.
- ↑ "DevTracker Programme DK-CVR-44623528-A102724". devtracker.fcdo.gov.uk. Retrieved 2024-07-15.
- ↑ 4.0 4.1 "Errata for Climate-Resilient Infrastructure Adaptive Design and Risk Management". Climate-Resilient Infrastructure. 2018-10-12. doi:10.1061/9780784415191.err. ISBN 978-0-7844-1519-1.
- ↑ "Climate Resilient Infrastructure Development Facility (CRIDF) | OKACOM". www.okacom.org. Retrieved 2024-07-15.
- ↑ "Climate Resilient Infrastructure Development Facility". intdevtetratecheurope.com (in Australian English). Retrieved 2024-07-15.
- ↑ "Climate Resilient Infrastructure Development Facility – SouthSouthNorth" (in English). Retrieved 2024-07-15.