Jump to content

Simbi

From Wikipedia

Simbi na wetin pipo wey kom from Sentra Afrika aria bilif sey na wota spirit or neshon spirit. Na pipo wey kom from Kongo an wey dey pratis tradishonal rilijion kari dis bilif for head pass. Oda aria wey pipo dey see enibodi wey dem kol Simbi as wota spirit na souta United State (pipo wey dey do Hoodoo) an Cuba pipo wey de Palo. Pipo stil bilif sey Simbi na wota pipo, mami wota (half fish and half human), snakes an faya.

Wen dey yuz by-force kari Bantu pipo komot from Afrika go Amerika, Di Bantu pipo kari dia bilif join bodi go Amerika. Bikos of dis one, meni pipo wey de kontri like United States, Brazil, Cuba, an Haiti bilif in Simbi wel wel.

Di Bakongo pipo bilif sey bisimbi na wota spirit wey get pawa (in kikongo: nkisi mia mamba) an dey fit hapiya as pesin, snake, kalabah pot, or Kalûnga wey bi flash of faya. Some pipo still bilif sey bisimbi fit hapiya as bird, trees an mammy wota.

Oda word wey wan risebu Simbi na isimba ia nsi wey min: pesin wey get levul for komuniti. Dis word isimba ia nsi na im we see for di kikongo dikshonari wey dem du in di Seventeen senturi. Oda word-dem wey wan risebu dis one na kísímbi kinsí wey min: di veri old pesin wey no dey eva kpai. Dis word kísímbi kinsí min sey di bilif sey Simbi get koneshon with di land of livin an di land of di dead.

Anoda word basimbi min: pesin wey dey tekia of anoda pesin an wen dey join as isimbi ia nsi e mins pesin wey dey tekia of di land

Pipo dey see bisimbi as di kontro neshon an na dem bi di link wey dey travul di Kalûnga Line bitwin Ku Seke (di fisika wold of di livin) an Ku Mpemba ( di spiritual wold of ancestor)