Jump to content

Samuel Chukwueze

From Wikipedia

Samuel Chimerenka Chukwueze (bon 22 May 1999) na Naijà futbola wey dey pley fo Villarreal an Naijà teem.

Hau e tek stat lif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Chukwueze fo Umuahia, Abia Stet. Na Igbo pesin an na fom Christian famili wit one broda an one sista. E go Government College Umuahia an Evangel Sekondri Skul. Na fom 8 years old e don stat to dey pley ball an e lik to dey pley lik as Okocha bikos e lik to bi lik am. E tok sey na Hon. Victor Apugo hep am an e ci am as im papa.

Na Amaokwe Ugba Ibeku, Umuahia, Abia Stet, Chukwueze join Villarreal CF's youth teem, fom lokal Klub Diamond Futbol Academy. Afta dem sign am dey put am fo smol teem, wey dey kol juvenil A, E kon leta join senior teem wit reserves on 15 April 2018, E enta sekond half fo Sergio Lozano wen dem pley 1-1 draw wit Segunda Division B Klub CE Sabadell FC.

Chukwueze first skore im senior goal on 20 May 2018, wen e skore sekond goal wen dem beat Atletico Bilbao 3-1. E hep im klub wit two goals an pley 11 times fo im first season, as im teem miss pley off to first Division.

Chukwueze first sho fo first-teem on 20 September 2018, wen e enta fo Nicola Sansone in a 2-2 draw fo home wit Rangers, fo di 2018-19 UEFA Europa League. E sho first fo League on 5 November 2018, wen e pley fo 90 minutes in 1-1 fo home wit Levante, fo di 2018-19 La Liga.

Fo April 2019, na im win di Naijà futbol Federation's young playa fo di year awod. On April 12 2022, Fo di sekond leg of 2021-22 UEFA Champions League quarter final away to Bayern Munich, na Chukwueze skore bak fo 88th minute 1-1 draw, na di goal hep Villarreal reech semi final fo di tournament.

Im wok fo Kontri

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta e don pley fo Naijà fo onda 17, dem lol am fo sinor teem in October 2018. E fes pley fo Naijà sinor teem on 20 November 2018, wen e stat fo dem on 0-0 draw match wit Uganda, di match na friendly match.

Fo May 2019, dem kol Chukwueze mek e kon pley fo Naijà sinor teem fo di Afrika kop of Nations an di onda 20 teem fo onda 20 wod kop. Villarreal tok sey Chukwueze fit onli pley fo one tournament.E kon sey na Naijà sinor teem fo Afrika kop of Nations fo Egypt na im go pley. E skore im first goal fo Naijà sinor teem fo Naijà 2-1 win wit South Afrika fo quarter final.

Im kain style

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni pipul don gree sey e dey pley lik Arjen Robben fo France bikos e get skil lik am.

Klob

Fo match e pley til 21 August 2022

Appearances and g, season and competition
Club Season League Copa del Rey Continental Total
DivisionAppsGoalsAppsGoalsAppsGoalsAppsGoals
Villarreal B 2017–18 Segunda División B 112112
2018–19 9292
Total 204204
Villarreal 2018–19 La Liga 265329(a)*1388
2019–20 37341414
2020–21 2841011(a)*1405
2021–22 273229(b)*2387
2022–23 20001(c)*030
Total 1201510530416024
Career total 1401910530418028
  • (a) Im game fo UEFA Europa League
  • (b) Im game fo UEFA Champions League
  • (c) Im game fo UEFA Europa League
Kontri

Fo match e pley til 9 June 2022

Appearances and goals by national team and year
National teamYearAppsGoals
Naijà national football team 201810
2019122
202041
202120
202251
Total244

Skores an di result wen Chukwueze Neva skore, di oda skore na wen Chukwueze skore.

List of international goals scored by Samuel Chukwueze
No. Date Venue Opponent Score Result Competition
110 July 2019Cairo International Stadium, Cairo, EgyptRSA1–02–12019 Afrika Cup of Nations
217 November 2019Setsoto Stadium, Maseru, LesothoLES2–14–22021 Afrika Cup of Nations qualification
313 November 2020Ogbe Stadium, Benin City, NigeriaSLE4–04–42021 Afrika Cup of Nations qualification
415 January 2022Roumdé Adjia Stadium, Garoua, CameroonSUD1–03–12021 Africa Cup of Nations

Villarreal

  • UEFA Europa League: 2020-21

Nigeria U17

  • FIFA U17 Wod Kop: 2015

Individual

  • FIFA U17 Wod Kop: Bronze Boot: 2015
  • DFA Most Influencial Playa of di year: 2016
  • MCL Kop Most Valuable Playa : 2016
  1. Samuel Chukwueze https://villarrealcf.es/en/first-team/squad/player/1569: Retrieved 2 August 2022

2.https://www.goal.com/en/news/samuel-chukwueze-makes-villarreal-debut-in-rangers

3.motivated Chukwueze wins award https://www.bbc.co.uk/sport/football/